Falz – Paper Lyrics (feat. Chillz)
[Chorus]
Dem say see danger oh
You no dey see danger oh
No go lose your center oh
All becasue of paper oh
Dem say see danger oh
You no dey see danger
No go lose your center oh
All because of paper oh
[Verse 1]
Yeah
Check
All because you want to live the fagi life
You ready to pay the price
Do the sacrifice
You ready to pay the price
Take your mama life
And even you no fit explain this your appetite
You want the benz
You no wan take the taxify
You wan order gold bottles
Maybe 35
You wan halla private jet things
When you catch flight
Now you don dey show werey love songs
You don dey bark for night
Skeletons in your closet
You murder to chow suppper
All the wraps of powder
You swallow to pass border
All the person pikin you carry for tight corner
I see you when you collect a good job
ga o la kpa
Dem say you talk say
You dey find raba
Dem say you go and dip your two hand
in foul matter
Oga this one you dey do
E pass arm robber
you turn criminal
Because you want to chow dollar
[Chorus]
Dem say see danger oh
You no dey see danger oh
No go lose your center oh
All because of paper oh
Dem say see danger oh
You no dey see danger
No go lose your centre oh
All because of paper oh
[Verse 2]
Yeah
Check
Ah
All because they offer you a little dollar
Na which kind foolish marriage
wey you throw your daughter
Small girl pikin wey her hero still be Dora
small pikin wey never suppose leave the mother
You need to hammer
You need to get the dough
E dey important
You want to chop national cake
You dey pray for contract
Dem give you ghana must go
Make you change the number
Voting never start
You don dey say your congrats
Why your people no fit hide this long throat
No go use your dirty hand
stain the white for my clothe
Mouth full of jokes
Hand full of notes
Oh I hear your people collect rice for some vote
Dem say you talk say you no like suffer
So you go and deep your two hands in our coffers
Oga this one you dey do e pass arm robber
throway moral
because you want to chow dollar
[Chorus]
Dem say see danger oh
You no dey see danger oh
No go lose your center oh
All becasue of paper oh
Dem say see danger oh
You no dey see danger
No go lose your center oh
All because of paper oh
Author Profile
- Raymond Onyebuchi is the Chief Editor and Web Developer at Naijawapaz Media. He has been publishing for over 6 years. He worked with some top media personalities in Nigeria like Munachi Abii. Raymond once owned a news website that ranked amongst the top 100 in Nigeria. He is tech-savvy, he loves gadgets and not really a fan of sports.
Latest entries
Foreign Song Lyrics2022.08.01AKA – Practice Lyrics
Foreign Song Lyrics2022.08.01Lil Durk – Play With Us Lyrics ft Kevin Gates
Foreign Song Lyrics2022.08.01Nine Inch Nails Ahead Of Ourselves Lyrics
Foreign Song Lyrics2022.08.01Kanye West – Ghost Town Lyrics Ft PARTYNEXTDOOR, John Legend, 070 Shake & Kid Cudi
Comment here