Lyrics

Simi ft. Falz Mind Your Bizness Lyrics

Simi ft. Falz Mind Your Bizness Lyrics
Lyrics Simi ft. Falz Mind Your Bizness

Hello
How far
I get gist for you o
Ah what’s up?
You know that girl with 20k followers on IG na
Which one?
That girl that is always shaking her bum bum
That is always doing
Oh keep popping
That girl suppose they carry filter anywhere wey she dey go o
Hehe…why na?
Omo baba na scam
Ehn?

Verse 1 – Simi

Why you too dey talk o?
Shey you no dey tire?
Ejo e nle njo wey no concern you
Na there them go find you
You no get work o
Na for your mouth dem go hear say Simisola get belle
(She don get belle)
Na for your mouth them go hear say Biliki dey sell pepper
(She sell pepper o)
Na for your mouth them go hear am
Busy body don come, may you fear am
Uncle face your work o

Chorus

Mind your business (Mind your business)
Who say make you no mind am
(Mind your business)
Busy body o
(Mind your business)
If you no like am
(Mind your business)

Gossip

Na lie
I no fit lie give you na
Kemi Sef dey there
I dey there
Her makeup don wash finish
Nothing to write home about
NO be that one come pain me passo
Na that her boyfriend

Verse 2 – Falz

Well done sir
Mr talker
Eku ise
Mr wetin no concern me reporter
Simi don marry Adekunle
But why?
Was Falz invited?
How is that your concem?
Why dont you face your work Aunty Uche?
You go chook your mouth everywhere like ekuke
You no dey let sleeping dog lie
Sweetheart Shey you know say na curiosity wey kill cat?
Leave talk, leave amebo, leave chat
Face front
Find business wey you fit start
Take tea. drink that. mind your biz wax
Open your ear when you’re listening to this track
Na for your mouth them go hear she buy three cars
But say she just use her mama do ritual (Amebo)
You say Sade just dey reach 32 years
But she never still marry, make she do fast

Chorus

Mind your business (Mind your business)
Who say make you no mind am
(Mind your business)
Busy body o
(Mind your business)
If you no like am
(Mind your business)

Gossip

Wait o
No be that her boyfriend wey dey give am porsche assurance?
Believe you me
Wetin I see no be porsche assurance
Na Okada assurance
Jesus!
God save us dear

Verse 3 – Simi

You dey put your mouth
For the thing wey no concern you
Alabosi ooo
The thing wey you dey find go find you

Chorus

Mind your business (Mind your business)
Who say make you no mind am
(Mind your business)
No be by force oh
(Mind your business)
If you no like am
(Mind your business)

Comment here